TRAILER TRASH

If you don dey yankee for long time, you go notice how dem get different areas for every town wey person fit live. Depending on ya money or skin color (yes oo, ya skin color mata) dem get dos wey dey live for main town (inner city), dos wey dey outside de main town (suburb) and dos wey dey live far from de main town (dem call am country, we dey call am village).

For each of dis area dem get dos wey get money, dos wey just dey struggle to survive and dos wey no too get. And de way dem divide de town, all man know where him level reach and na dia you go go find house. Most times, onyibo dey dem own side, akata dey dem own side and de latinos dey dem own side.

But ee get some kind people wey just dey different from every body. Dem no belong to any group and de way dem dey live dem life
 just tire every body. Dos na de people wey dem dey call TRAILER TRASH. Dem dey for dem own different area.
Trailer trash na people wey no gree live for any part of town wey get regular house. Infact dem dey live for wetin dem  call trailer park. Dis na container wey get tires. And inside de trailer, you go see bed, kitchen, toilet and bathroom. De inside dey very small. And de surrounding na one kind…., if you know as tins dey scatter scatter for any mechanic shade, na so de outside be. Wetin I dey compare sef? Mechanic shade na Aso Rock compare to dis places.

For some, you no go even see where to put leg. Na so tall grass cover everywhere. And you go see as cats and any how dogs go just dey waka everywhere. I trust say if any of dem bite you, you go catch rabies one hand! Almost all de town you enter, you go find one section wey dis guys put dem ‘house’. Na dia you go find almost all de drug addicts. And na dia ashawo liason office dey normally dey.

And de populaton dey be mostly onyibo people. Dem get some akata and latinos too. But na mainly oyinbo. Na im make dem dey call most people wey dey live for dis kind area WHITE TRASH. I tell you, most of dis people get moto and dey work. No be like say dem no fit go live for any beta place or clean dem surrounding, dem just like to live like dat. And nothing you go tell dem wey go make dem change dem life style.

Person poor and no fit find beta house, dat na one tin. But to decide to live for dirty environment and no send at all? Lol. Plenty places for yankee fine oo! No get me wrong. But ee get de kind places wey you go see, like de ‘trailer trash’ places, you go clean ya eye plenty times to make sure say na yankee you dey!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...