HOW YOU FIT BUY ALCOHOL FOR YANKEE

Alcohol na big business for yankee. Everywhere you turn na so you go see where dem dey sell de tin. For tv, na so beer or wine or whiskey advert go block wetin you wan watch. Dem sponsor sports, dem sponsor movies and dem even sponsor some tins wey government dey do.

But de way dem dey show alcohol for tv and sign board and everywhere, no be same way dem dey let people buy de tin. For yankee, you no fit just enter de place where dem dey sell beer and just buy am like say you wan buy sweet. Dem get plenty rules of how dem dey sell alcohol.

De first rule na say dem get age wey you suppose reach before you fit buy beer. And dat age na 21 years. You must show
 ID card before dem fit sell you alcohol. If you no carry ID card, you no go buy alcohol. Dem go only sell to you without ID, if you get gray hair for ya head.

Anoda tin be say, all de 50 states get dem own law as dem wan sell alcohol. Some go stop to sell afta 12 for morning, some states dey stop by 2 for morning. Some states no dey sell for Sunday. Even some no dey sell wine and beer for de same store.

For most states, dem get wetin dem call ‘dry county’ and ‘wet county’. County na wetin we dey call local government area. Dry county na where dem no dey sell alcohol and wet county na place wey dem fit sell alcohol. But sometimes, when dem say wet county dem really mean say you no get alcohol for store, but you fit buy am for restaurant and drink am dia.

Imagine as we dey do for naija, where you fit send small pikin to go buy you beer for ‘mama uche’ store, if you try send any under age dat one, na for police station you go find ya sef. But one interesting tin wey dem get be say under age person fit drink alcohol only if ya papa or mama dey dia and go gree to allow you drink. Infact, ya papa or mama fit carry you go bar and buy alcohol for you.

All dis one neva stop small pikin dem to drink. Some go make fake ID to use buy de tin or dem go beg dem friend wey don reach 21 years to helep dem buy alcohol. Arrest or no arrest, most under age no send.

De types of beer and wine wey dem get, dey uncountable. Ee get some store where be say na only alcohol dem dey sell, dem call am ‘liquor store’. If you no know de type wey you want na so you go waka round de store tire. Dem get some type for just women like margarita and some type for dos wey get ‘strong liver’. And if you enter most bar na so dem get plenty types wey dem go mix for you. And some of de names of de mix go make you wonder. Some names na, ‘sex in de bitch’, ‘earthquake’, ‘hi-fi’. De names plenty no be small.

Alcohol na big business for yankee. And for dos wey dey drink am get serious rules wey dem suppose obey. If you obey dem, you no get wahala. But if you decide to disobey dem, you and police go enter serious gbege wey go land you for place where you no fit imagine. To break any alcohol law for yankee be like to stand for front of train wey dey come with full speed. Later, I go take my time break down de tins wey fit happen to any person wey break alcohol rule for yankee!!!!

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...