SURPRISE SURPRISE!!

**Abeg oo, make any person wey read dis post no tink say I dey look down on any group of people. Na   just experience wey happen to me wey I no expect!

All my life, at least when I mature and come begin decide who go barber my hair, I dey always dey careful about who I allow to touch my hair. Once I enter any babershop and dem no cut am de way I like, na bye bye to dat barber shop.

And den when I come yankee, na de same tin. I dey always dey careful with my hair. Infact ee take me like 3 months before I cut my hair for de first time. I dey busy dey find where to cut my hair. As person from Africa, no be any barber shop wey you see wey you go just enter to cut ya hair. I go explain why ee be like dat.

TINS WEY GO SURPRISE YOU WHEN YOU ENTER YANKEE

For today post, I wan try to list out some of de tins wey you go notice for yankee wey dey different from wetin you dey used to. And when some of dem go take you some time before you adjust to am. Make you check dem out!
  • When you sneeze, anybody wey dey around you suppose tell you "Bless You". Dat one confuse me de first time wey ee happen to me. For Naija when you sneeze, you wey sneeze suppose say "excuse me".
  • When you wan write date, you suppose write month first den day and den de year. For example if you wan write de date for today, you go write- 10/19/2014. For Naija ee suppose be 19/10/2014.

ANODA HALLOWEEN DEY COME!

De time don reach again wey people go dey dress like ghosts and zombie dey waka everywhere. Dis year, ee go happen for October 31. And for most supermarkets, dem don dey prepare. Na so you go see "halloween" sections where you go fit buy all de tins wey you need to celebrate dat day.

As person wey enter yankee new, de halloween tin no comot road for me. And when I tell people around me say we no dey celebrate halloween, na so dem go dey surprise (Yes oo, yankee people dey always surprise when dem see foreigner wey no dey celebrate any of dem holidays. Dem dey always tink say de whole world dey do every tin wey dem dey do for here, lol).

B na for BITCH

"Bitch! If you no comot for my face, I go bitch slap you!". "Shut up ya mouth, bitch ass nigga!". "No mata wetin you do, you go always be my bitch". Dis na some of de yan wey one guy and him babe just dey go back and forth for de parking lot for one walmart store.

Wetin start dem quarrel, me I no sabi. But wetin I know be say dem use de word bitch like 200 times (na wetin my mind tell me, lol). If you see as dem just dey call dem sef bitch, you go tink say na both of dem name. Na wa for dis word oo!

HOUSE WEY YOU FIT DRIVE

Yes oo! I been enter for one of dos kind house for summer! Me and my babe plan dis trip from Texas to Indiana. So we decide to rent dis house-RV (recreational vehicle be wetin dem dey call am for here).

De one wey we rent get everytin inside. Ee get bed to sleep. Ee even get small kitchen wey you fit cook, and bathroom and toilet dey inside. Na small one bedroom flat wey ee dey like inside. De money wey I spend to hire dis tin no loss at all.

De day we start de journey, I put enough clean wata for de tank wey go supply wata for de kitchen sink and toilet. And den I check de tank wey go collect toilet, bathroom and kitchen sink dirty wata. Dis one na wetin you suppose do before you start ya waka.
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...