B na for BITCH

"Bitch! If you no comot for my face, I go bitch slap you!". "Shut up ya mouth, bitch ass nigga!". "No mata wetin you do, you go always be my bitch". Dis na some of de yan wey one guy and him babe just dey go back and forth for de parking lot for one walmart store.

Wetin start dem quarrel, me I no sabi. But wetin I know be say dem use de word bitch like 200 times (na wetin my mind tell me, lol). If you see as dem just dey call dem sef bitch, you go tink say na both of dem name. Na wa for dis word oo!

De original meaning of bitch na woman dog, but for yankee, I no tink say anybody dey use am to describe woman dog. Na so so insult wey people dey use am for. Na mostly to yab women. If you really wan make any woman for here go off, just call am bitch. De word carry heavy weight like when you call woman for Naija ashewo!

Ashewo and bitch almost mean de same tin. But the word bitch dey more sophisticated. Depending on de mood wey you dey, de person you dey use am on, and de place wey you dey, bitch fit mean different tins.

If you dey prison, de word bitch mean..., well we all know wetin dat one mean, abi? lol! Den if a guy or babe wan really make any woman vex well well, den bitch go be de best word to use. If you wan make any guy to feel inferior, you fit call am bitch, some guys no go waste time to break ya head if you call dem dat one.

And de one wey dey surprise me well well na when some women dey use am to describe dem sef. For yankee, if any woman tell you say she be bitch, make you run 440 for ya life. Dat na babe you no wan mess with when she vex. Na de ones dem dey call "bad ass bitch!". Imagine for Naija, if any woman tell you say she be correct jaguda, I dey sure say you no go wan make dat kind woman vex.

Now dis word bitch don tey wey people dey use am. In fact de word don dey since de fourteenth century. But na de rappers wey make de word to dey as popular as ee dey now for here. All of dem dey describe women as bitches and hoes (no be hoe wey you dey use for ya farm oo, ee mean asehwo too)! De unfortunate tin be say plenty women don accept am and dey use am among dem sef, and some dey even use am as compliment, Chai!

Every culture get words wey dem dey use as yabis. Dat one na normal tin. But when de same word wey people dey use curse oda people come be de same word wey some people dey use describe dem sef and still dey proud of am, dat one get as ee be. Like as akata people dey use NIGGA to greet each oda, or guys dey call dem seef dogs and cats! I neva still fit understand de sense wey dey for dis behavior.

And den when I see as small girls dey call dem sef bitch (especially among akata people), na so my heart go "bleed" with pity. No woman wey know her worth suppose allow any person to call a bicth, and no woman wey get any sense for her head suppose describe her sef as BITCH!

P.S: I just notice say dis word bitch just full for dis my post, lol!




No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...