GUN SHOPS, GUN SHOWS and SHOOTING RANGE

 

Na wa oo. See me see wahala oo! Na so one of my friends call me for dis past weekend say make I follow am go SHOOTING RANGE. Dis one na place wey you fit go practice how to shoot. See me wey dey fia gun like no man business.

But as pessin wey dey like experience new tins, and I no wan behave like fia fia man, na so I gree go with am. Omo, gun range no be anyhow place oo! If you no get mind, you no go fit enter de place. Dem get different sections for a typical gun range. Ee get place wey you go go sign ya name. Dem go run security check for ya name to see weda you dey legal to handle "fire arm"(gun).

Den you go choose de type of gun wey you go like practice with. Nna men, na small pistol I choose oo, make I no go carry wetin I go shoot, and ee go carry me fly troway. Ee get workers dia wey go teach you how to handle de gun wey you choose. How to load am with bullet, how to cock am, how to aim am, and how to position yasef as you wan shoot.

See me see as I dey position to shoot gun. I no go lie, na so my hand been dey shake small small. You fit shoot inside or outside. Outside own na mainly to shoot those heavy duty weapons dem. No be dat one I come to shoot oo! I come hia to mainly respect mysef with de small weapon dem. My friend na old skool for shooting, and na big guns him dey handle.


Shooting range na popular place wey most Americans dey like to visit. You know say to get gun for hia dey legal. So na for dis gun range dem wey scatter for everywhere wey people dey go learn how to shoot. You fit carry ya own gun come learn how to shoot. Na wetin most people dey do.

Gun business na multi-billion dollar business for hia. Dem get plenty shops wey dem own na to sell weapons to citizens. As far as you no get any serious criminal records, you fit buy any type of gun. Even sef for some states, you fit buy as many types of weapons wey you wan buy. And most of dis shops dey even sell to customers online, you no even need to come for dem shop to buy ya gun.

And na dis shops dem dey operate de gun range wey you fit come learn how to shoot. But some people don dey fight against selling of guns. Some people say na because of how easy ee dey for people to buy guns, na im make gun dey enter some evil and craze people hand. And na im dey cause all dis mass shootings wey dey happen from time to time. Even sef some lawmakers dey try to ban selling of guns to ordinary Americans.

I just dey wonder weda ee go ever dey possible for naija where govment go allow people to open gun shop and gun range. Ee go ever dey possible?



DOWNLOAD THIS E-BOOK: https://www.amazon.com/dp/B09RJW7QNR

1 comment:

  1. Hahahahahahahahahahhaahhagagaga this one sweet me for belle.... Ordinary small gun you dey fia.

    I no think say e go dey possible for naija hia..bcos haha if government allow am naim be say everybody for naija go die. The crime rate don too much already, then Dem wan come open gun shops? Ha

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...