You know say pessin fit dey house finish all im education from kindergarten to SS3? Yes dis one surprise me when I find out say ee dey possible. And ee dey popular for here.
To make ya pikin to go skool from house, you need to obey some laws wey de govement for ya state go give you. And you get to buy de textbooks and oda skool tins wey regular skool students need. You need to dey supervise ya pikin and to make sure say dem dey do all dem skool work. Dem get to write test and exams to show say dem dey do dem skool work.
Most of de parents wey dey do dis one na dos wey feel say regular skools no dey teach dem pikin well, or dem feel say de skool no dey safe for dem pikin, or dem feel say de skool dey spoil dem pikin. Some parents wey dey travel well well dey prefer to teach dem pikin for house.
Some research don find out say pikin wey go skool for house dey sabi book pass some wey go regular skool. Dis one fit be because of say de papa and mama make sure say de pikin do dem skool work.
MY FIRST WAKA TO DENTIST OFFICE
Abeg oo, make you no call me bushman afta you finish to read dis post. No be my fault say I neva visit dentist office before until 23rd December. I neva see any reason to visit any dentist. I neva get any serious tooth ache before. And anytime I look for mirror when I dey brush my teeth, I dey feel say de tin dey clean.
Come to tink of am..., na who we you know for Naija wey dey regularly go dentist office for check up? Anybody wey I know wey don go see dentist, been go because im get problem with im teeth. Our usual way na "cure before prevention".

RACISM REACH FOR BURIAL GROUND
Nothing dey jolly about tory wey concern burial ground. Na place wey everybody know say na dem final destination, but nobody wan really talk about am. But ee get some people wey get enough liver to talk about am.
In fact, I don jam people wey don make arrangement about dem own burial. Even sef, dem don buy plot of land and build dem own grave. I don see family wey don buy space or burial ground and come share space for every member of dem family!
For my village, if pessin die, na for im family compound dem go bury am. Some dey even bury inside house. Like when my granpapa die (I no meet am sha), dem bury am inside him room. De same tin too happen when dem bury my popsi mama.

GROCERY SHOPPING
Now to my fellow guys wey dey Naija, make I ask una sometin. You remember de last time wey you and ya wife or ya significant oda go market to buy tins. You still remember as she make you carry all de tins wey una buy? You just de follow her for yansh and dey frown ya face like pessin wey lick lime. But you no fit talk anytin because say you no wan hear her mouth.
Hmmmm......, Naija guy go gree follow him woman go market to go hold shopping bag for her? Unto which levels wey dat one go happen? Naija men and dia ego wey big pass dem head, go gree follow dem wife go market or go helep her buy house tins? "A whole Him"!

TYPICAL YANKEE APARTMENT(FLAT) part 1
For dos wey no know wetin apartment(flat) for yankee be like, dem go learn new tins from dis post. And dos wey dey live for apartment for yankee go agree with me. I purposely wan talk about apartments because na de one I sabi well well and na de most common type of "house" wey people dey live. And na de one wey my money reach. I neva get enough money to rent or buy house.
Now you need to understand say de way wey we de use dat word- house, no be de same way dem dey use am here. House for here na place wey get im own separate compund and sometimes im own fence. And you no get to share anytin with any oda person.

DOUBLE DIPPING
Wetin I wan talk about for dis post fit surprise some people. De tin too been surprise me de first time wey I experience am. For yankee, I notice say people no like to eat from de same plate with anoda person. Dem dey call am double dipping!!
Me and one babe been dey on a dinner date one day. So as we dey eat, she come tell me say she no like de meat wey dey her plate. Well...., I stretch my hand with my fork to collect de meat from her plate. Den I come notice dis frown for her face. She say I no suppose do like dat.

EVERY STATE GET DEM OWN FLAG
De main identity of any country na dem flag. You go see each country flag during olympics or world cup or for front of dem embassy. People dey use dem flag to connect with oda of dem country people. Once you see ya country flag anywhere outside ya country, you go know say ya country person dey around dat area.
Most big cities for yankee dey allow foreigners to celebrate dia independence day, and each country dey fly dem flag like no man business. October 1st for most big cities like new york, dallas, los angeles and maryland na green-white-green everywhere. Naija music and food plenty yanfu yanfu.

BROWN, GARNER AND OBAMA DAUGHTERS
Nobody wey dey live for dis country go say im no notice de tension wey don dey go on for one week now. No be news say korofo and citizens no too dey friendly for dis country, especially between korofo and akata people. Almost everyday, you go hia complain of bad tins wey police don do.
And for de past seven days, tension just dey grow for most part of de country. People dey protest wetin don dey happen for missouri and new york. For de place wey dem dey call ferguson wey dey missouri, one olokpa (darren wilson) shoot one boy (Michael Brown) six times, leave im dead body for road for four hours. And de case don dey on since august. Den last week, de grand jury come out with dem judgement- NOT GUILTY!! Say de police man no do anytin wrong.

ME AND MY BICYCLE
"Are you ok? Do you need any help?". As I hear dis quesions and come turn around to reply de person wey ask me de quesions, him and de woman wey him been stand with just rush enter dem house. Wetin just happen? I stand dia like person wey see ghost. I still dey try to figure out de drama wey just happen.
Na afta I come yankee wey begin like to ride bicycle. Well..., I really no like am like dat. De tin start with de situation wey I been find my sef. When I been dey skool and I seriously need transport to and from my classes, but no get money to buy moto or enough money to enter bus or taxi, I come decide to buy bicycle.
See me wey no even get bicycle for Naija. I no know de last time wey I ride bike for Naija. Awa roads no dey good to ride bicycle. And de way we dey drive moto, I no go advice anybody to begin ride bike.

THANKSGIVING
Yes oo, de day wey de life of all de tolotolo no dey sef don come again! Dem dey call am thanksgiving day. Na de day wey everybody suppose tank God for all de good tins wey Him don for am. Na serious jolly time wey people dey over eat and over drink. And today take style dey more important pass xmas for some people.
And I say tolotolo dey trouble today because na de "official" meat wey everybody dey cook today (chicken and cow and pig get to rest small for at least 24hrs!). But ee get one special tolotolo wey go get "presidential pardon" today. Ee get tradition for white house where de presido go officially pardon one turkey, and nobody go kill am for chop.

TO MY SISTAS FOR YANKEE (follow up)
I been read dis blog post wey @NewDawn write. For de post she been dey discuss how one Naija babe take dump one Naija guy wey her pastor introduce to her. Wetin be her reason? De guy no be wetin she been dey expect am to be. Basically, she mean say de guy no reach her level.
Well..., everybody get dem right to marry OR no marry anybody. Na dem right and I gree with dem for dat one. But wetin no sweet my bele about de whole post na de analysis wey @NewDawn been try to give for why de babe dump my guy.

WINTER DON COME AGAIN!! part 2
Part 1
When de wata for de pipe don block, de next tin na to break de pipe. And to stay without wata during winter no be wetin anybody wan joke with. So to avoid dis one, you go open ya tap small so da wata go continuously dey flow. Dis one go stop de wata for pipe to form ice block.
For de past three days, de cold for here no get part two. De kind snow wey don fall for some states plenty well well. Place like New York don get snow for dis three days wey dey equal to de kind snow wey dem dey get for de whole winter season. We for Texas dey lucky say snow no dey fall too much.
In fact, snow dey hardly fall for Texas. Anytime wey ee try fall na so people go dey behave like say manna dey fall from heaven. Children go dey play with de snow. Some go build "snow man", odas go mold am like ball dey stone each oda.

MARCHING BAND
Me I been attend navy nursery, navy primary and navy secondary skool. Wetin remain na to attend for "navy university", lol. But na for Uniport I for finish. Dat one no mean say I no try to go Nigerian Defence Academy. I try to buy de for but my mama no wan take ear hia any tin wey get to do with her pikin and souja work. Na so dat dream take end like dat.
I still remember all dos early morning assembly and marching wey we been dey do primary and secondary skool. Afta all de anouncement and oda gbogbotigbo wey dey take place, de drum boys go begin play and den each class go march go dem class. I remember as guys dey try come early so dat dem go follow for dos wey go play de marching drums. Na one of dos small tins wey dey make me wan reach skool very early. My favorite drum na de small one wey you go hang around ya waste and come play with dos two small sticks.

MOONSHINE, OYIBO PEOPLE KAIKAI
Me and drinks sef, we dey like five and six. Na beer be my drink. Any day any time, na beer I prefer. Sometimes I go drink wine or hot drink. I no too like dis ones. Wine or hot drink dey shack me quick quick. All my friends know say anytime I wan drink, na beer be my choice of "poison".
Guilder be my friend for Naija. "The ultimate" and me dey like five and six. If guilder no dey den I fit go for Star. But as Guilder or Star no dey for yankee and person get to drink beer, I dey "manage" de brands wey dem get here. Most of de beer here dey like wata to me, lol. De tin no dey enter my body like my Guilder. Infact I dey drink am like say na wata I dey drink.

WINTER DON COME AGAIN!! part 1
Dat time of de year when I hate well well don come again oo! Yes, winter season don begin for Texas wey I dey live. Temprature don begin fall to around 33 degrees Farenheit (1.7 degrees Celcius). I remember de initial time when I come yankee, de cold for winter almost freeze me one day. I wear de wrong jacket to go skool. Na so I begin shake like leaf. My fingers come strong kakaraka like stone and na so my ear almost break comot. De more I dey breath, de more I dey feel like say I dey inside freezer.
People been dey tell me say make I no worry, say I go dey used to am. I don dey here for almost seven years, and I go tell you say I neva still dey used to winter. To me, ee dey like say every year de cold dey increase. Me and cold no get any business. Even when I been dey Naija, I been no like harmattan at all. I remember when I been visit Abuja for harmattan, na so I dey wear two sweater any time I wan comot for house.

HOUSE HELP
"Cleaning help wanted, must be able to work independently", "nanny wanted urgently". Dis na some of de adverts you go dey see for newspaper or for websites like craigslist. For here, if you need house help, you no go just carry person pikin as we dey do for Naija den come make am to do all ya housework.
You must specify de kind work wey you wan make de person to do. If na to clean ya house, look afta ya small pikin, or to clean ya compound, you go find person to do dat work for you. And everytin for hia boil down to one tin-money. Dis one go depend how many hours or days de person go do de work for you.

SURPRISE SURPRISE!!
**Abeg oo, make any person wey read dis post no tink say I dey look down on any group of people. Na just experience wey happen to me wey I no expect!
All my life, at least when I mature and come begin decide who go barber my hair, I dey always dey careful about who I allow to touch my hair. Once I enter any babershop and dem no cut am de way I like, na bye bye to dat barber shop.
And den when I come yankee, na de same tin. I dey always dey careful with my hair. Infact ee take me like 3 months before I cut my hair for de first time. I dey busy dey find where to cut my hair. As person from Africa, no be any barber shop wey you see wey you go just enter to cut ya hair. I go explain why ee be like dat.

TINS WEY GO SURPRISE YOU WHEN YOU ENTER YANKEE
For today post, I wan try to list out some of de tins wey you go notice for yankee wey dey different from wetin you dey used to. And when some of dem go take you some time before you adjust to am. Make you check dem out!
- When you sneeze, anybody wey dey around you suppose tell you "Bless You". Dat one confuse me de first time wey ee happen to me. For Naija when you sneeze, you wey sneeze suppose say "excuse me".
- When you wan write date, you suppose write month first den day and den de year. For example if you wan write de date for today, you go write- 10/19/2014. For Naija ee suppose be 19/10/2014.
ANODA HALLOWEEN DEY COME!
De time don reach again wey people go dey dress like ghosts and zombie dey waka everywhere. Dis year, ee go happen for October 31. And for most supermarkets, dem don dey prepare. Na so you go see "halloween" sections where you go fit buy all de tins wey you need to celebrate dat day.
As person wey enter yankee new, de halloween tin no comot road for me. And when I tell people around me say we no dey celebrate halloween, na so dem go dey surprise (Yes oo, yankee people dey always surprise when dem see foreigner wey no dey celebrate any of dem holidays. Dem dey always tink say de whole world dey do every tin wey dem dey do for here, lol).

B na for BITCH
"Bitch! If you no comot for my face, I go bitch slap you!". "Shut up ya mouth, bitch ass nigga!". "No mata wetin you do, you go always be my bitch". Dis na some of de yan wey one guy and him babe just dey go back and forth for de parking lot for one walmart store.
Wetin start dem quarrel, me I no sabi. But wetin I know be say dem use de word bitch like 200 times (na wetin my mind tell me, lol). If you see as dem just dey call dem sef bitch, you go tink say na both of dem name. Na wa for dis word oo!

Subscribe to:
Posts (Atom)