ADOPTION- how to turn anoda pessin pikin to ya own

I wan make you imagine de kind tins wey been dey go on for my mind when one of my co-workers introduce him pikin to me. My co-worker na white woman, and her pikin na black boy. Initially I been tink say I no hia detin wey she tell me. I been tink say my ear dey deceive me. Ee take me some time to process wetin just happen. Why de tin surprise well well, I no really know!!

Well, may be na sake of say dat time, I still dey new to yankee and I neva too dey familiar with dem culture of adoption. Na later I come find out say de tin dey very common for hia. Some couples fit decide to no born pikin of dem own, and dem go go adopt. Now color no dey too mata when people dey adopt.

Plenty times I don meet family where plus de ones wey dem born, dem go adopt one or two more pikin. And dem go talk about am like say na normal tin. Sometimes when husband and wife don train de pikin wey dem born, and de house don empty, dem go adopt oda small pikin. I remember my professor wey supervise my project..., him show me photo of him pikin dem. Only three out of de eight pikin wey him show me be de ones wey him and him wife born!

No be small shock wey if feel when him tell me dis one. And some of de ones wey dem adopt even senior some of him own 'real' pikin. And my guy no send..., him dey train all of dem equal. If him no tell you, you no go know. But wetin really surprise me about de man na de way wey him tell me about him pikin dem. Him tell me de tin very casual like ee no mean anytin!

Some pikin wey dem adopt go tell you say dem adopt dem, like say na normal tin. No need to begin hide anytin or shame about say dem adopt dem. You go see as some family just dey like micro united nations. Almost every race dey for de family. Nobody send.

But adoption hia no be bread and butter every time. Some papa and mama no go tell de pikin, and den when de pikin grow im go come find out. Most times, ee go spoil de pikin mind well well. Some go even begin hate im papa and mama. Sometimes ee dey even dey worse as de pikin fit suffer rape!!

Yes..., ee don happen plenty times. Pessin wey you tink say na ya papa or mama go begin rape you! And den you go later find out say dem adopt you. Dat one na real "double wahala for dedi body". Some of dem no dey eva recover from de experience.

 So na im make currently, de agency wey dey adopt pikin dey try dey very careful before dem give you any pikin. And na im make most people dey go abroad to go adopt, because de kind conditions wey some of de adoption agencies dey give people hia. Dem go prefer to go anoda country where de wahala to adopt no dey too much.

Adoption culture na sometin wey no dey common for naija. People neva train de pikin wey dem born finish, na to go carry anoda pessin pikin wahala for head wey dem wan do? Awa culture wey to drag property dey very important, which woman go wan make her own pikin share her husband property with pikin wey she no born? Even sef to share property with step pikin dey hard some wife, not to talk of pikin wey dem adopt!

But me sha.., I no get anytin wrong with adoption. Pikin wey dem abandon plenty everywhere!! And if you get de recourses to train anoda pessin pikin like say na ya own, abeg make you close mind do am. Na one good tin wey we know say na only God fit reward pessin. And dos wey dey do am.., na maximum respect I get for dem. No be easy tin to do, at all at all!


NIGERIAN NEWS, NIGERIAN NEWSPAPER, OSHIOMHOLE,  OBASANJO, BUHARI, AMAECHI, TINUBU, GEJ, KESHI, SUPER EAGLES, CHELSEA, LARA FORTES, WIZKID, DAVIDO, LINDA IKEJI, DON JAZZY, JAY Z, OBAMA, JUSTIN BIEBER, DRAKE, CHRIS BROWN


No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...