You know say when pessin say wondas shall neva end!, dat pessin dey talk about sometin wey really surprise am? Yes dat one happen to me recently. I find out about dis people wey dem dey call Amish for de frst time.
I dey drive for road one day, den I come see dis guy and im woman been dey drive dem horse and cart. Dis one na wetin I see for township. Na sometin wey I no eva tink say I fit see for dis side of town.
TAPIOKA or ABACHA
Abeg oo my naija brodas and sistas for yankee, una fit tell me where I fit buy some tapioka for dis country. I don check walmart, krogers, brookshires for dis tin, and none of dem get am. I done waka up and down to find me some cassava flakes to chop, and nobody get am.
Lol..., but seriously I no know wetin just do me today, but from nowhere tapioka just enter my head. And when ee enter my head, ee take style shock me, like seriously!! Na dis tin wey oyibo dey call flashback. And make I tell you..., de flashback really take me go places..., I swear!!

AKATA WOMEN BEEN DEY BREASTFEED OYIBO PIKIN DEM
If you don watch dat film wey im name na THE HELP, you go see as life been dey for yankee around 1950s. Dat time, na mostly akata women dey do house helep work for onyibo women. And dat time, na de most popular work wey akata women fit get.
But dis tin no really start today. Even for way back, na akata women been dey take care of onyibo pikin dem. Wetin dat one mean na say onyibo pikin dey spend more time with akata house helep pass dem own mama.

'LOVE' TATTOOS
I no like tattoo since time imo river. I no fit see my sef enter tattoo palor, den com sidon make anoda pessin use pin dey chook my body with dat dem electric pin. And den come begin inject my body with dem ink. My body na no go area for tattoo.
But when I look around, na so almost every pessin get tattoo for body. People dey get am for every part of dem body. Just tink of any part, somebody get tattoo for dat area. And tattoo business her dey very big. Na none stop customers wey dem dey get.

NAIRA VS DOLLAR EXCHANGE RATE
Dis post na some kind of true confession. All of us know say aside from de beta life wey we dey travel abroad for, anoda big reason wey we dey travel abroad and de country wey we dey choose, dey depend on de exchange rate of de currency of dat country money to NAIRA.
Why wey dey like to travel to countries like USA, Canada, UK and so on, na because dem currency dey high. Na one of de reason me I decide to come yankee. When you make dat dollar and den press ya calculator to see how much ee be for naira, ee dey give you confido.

YOU NO FIT SEND ANY SMALL PIKIN MESSAGE FOR YANKEE
You know..., sometimes ee get de kind of tins wey you see or experience around you for dis yankee wey go make you miss naija. Some kind tins wey you fit do or say for naija and no mean any tin, but if you do am for hia, ee fit land you for serious wahala.
To discipline pikin hia na no no. No even tink am! Even sef, you no get right to discipline ya pikin de way you want. If you do dat one, na im be say na police attention wey you dey find. I know some parents wey dey even fia dem own pikin wey dem born.

AKATA COMEDIANS
One of de ways wey I dey take pass time when I no get anytin to do, na to go for youtube to watch jokes from stand up comedy. Sometimes, I go spend hours just dey watch stand up comedy. I go watch white, akata, latino and even naija stand up comedian.
But I dey usually enjoy akata stand up comedy. De style of dis comedians just dey different. Dem no get filter for dem mouth when ee come to POLITICALLY CORRECT topics. Dem go talk about any and every tin. Dem no send at all.

DARK SKIN vs LIGHT SKIN
Among akata people for hia, dem get dis tin wey dem dey always argue about. Dat tin na de color of dem skin. Yes oo! Dos wey get light skin dey tink say dem beta pass dos wey get dark skin. And dos wey get dark skin no like light skin people.
Dis tin wey I dey tell you be VERY serious mata for hia. Ee dey even cause serious quarel for among family members. Light skin family members dey feel say dem beta pass dos wey get dark skin. Even sef some parents dey show more love to de pikin dem wey get light skin. Dis na sometin wey I don witness with my own korokoro eyes.

Labels:
NA WA OO!
WE FOR YANKEE SUPPOSE TANK GOD FOR SOME KIND TINS WEY WE DEY ENJOY FOR HIA
To begin talk say yankee no get light problem go be very old tory. Yes we know say when ee come to steady light, we naija no fit compare to yankee people. But I dey hia say light don dey dey steady small small since oga Buhari take ova.
Abi na oda tins like say nobody still dey wash cloth for hand, or say wata dey reach everybody house, or say coal tar reach ya very domot e.t.c. Ee get oda plenty plenty tins wey dey for dis yankee wey dey make life to dey very easy for pessin.
No wonda say afta we wey be foreigners complain of how dem dey treat us bad (racism) and how we dey miss we country, still nobody wan go back to where im come from. Deep down you know for ya mind say tins for hia still beta pass where you come from.

YOU MISS NAIJA
BACKGROUND CHECK
For dis place eh, dem go check you up and down, even sef ee remain dem to check ya pant to see weda you get anytin wey you dey hide. I dey talk dis one as ee take concern de tin wey dem dey call background check. Afta you don apply for work, or even as you dey fill de application form, you go see space wey dem go ask you if you do commit any crime before.
MY YANKEE FRIEND NO GO LET ME REST
Dis people no wan let me rest anytime dem come my house when I dey cook. Na so I go dey hia tins like- wetin be dat? Na wa oo..., wetin die for ya house? Wetin be dat tin wey you like to cook wey dey smell like rat wey don die for long?
See me see wahala oo! How wetin I dey cook for my own house come dey concern dem like dis? Anyway sha..., de tin wey dey worry my friends nose na my crayfish and dry fish wey I dey use cook. Dis na sometin wey no dey common hia. Even sef, most people hia no even know say you fit dry fish.
Anytime pessin wey I know travel to naija, I dey always get plenty supply for soup tins. Me I like to cook naija food for hia. Dem fast food no dey gree master my body.
But my friends dey always like my food anytime when I cook am finish. Dem go chop and almost lick plate. So de tin dey surprise me as dem no fit stand de smell of crayfish and dried fish.
Well me I don dey use to de smell sotey ee no dey even enter my mind say dis tins get bad smell. and me I no get any plan to stop to use dis tins when I dey cook. My yankee friends just need to adjust dem nose to de smell of my ingredients oo!!

MARTIN LUTHER KING BOULEVARD
As me and one of my friends been dey stroll for him moto one day, we reach one junction like dat. Den I come tell am to turn left so dat we fit see wetin dey dat street. My friend say lai lai him no go enter dat street for dis night.
'Ah ah.., wetin do de street?', be wetin I come ask am. My guy come tell me say dis side of town na de rough side- na de south side. I come later find out say de name of de street na MLK boulevard. Dis na short form for Martin Luther King boulevard.

MY FIRST RODEO
How many of una don ride horse before? For dos of una wey don ride am, how de tin dey feel for body? Me I neva fit get de mind to climb horse back. Ee dey always dey me like say de horse go fling me like stone from catapult.
Now na how many of una don ride cow? Yes I mean nama! Lol. I know say dat quesion get as ee be. But make dat one no too surprise you oo! Dis na because for hia for yankee, ee get one kind special sports wey people dey ride cow. Dem dey call am RODEO.
Labels:
SPORTS
TRANSGENDER PEOPLE
No be small tin oo! Pessin wey God create finish, go look im sef for mirror den decide by im sef say God been make mistake to create am as man or woman. Den dat pessin go use im own hand come change im sef to anoda tin. Cold catch me for dis one!!
I tink by now everybody don sabi say for yankee, de tin wey dem claim say dem get yanfu yanfu na say everybody get de freedom to do anytin wey dem like, unless say dem no break any law. But if you don live for dis country tey, you go sabi say dat talk about freedom no be as dem dey talk am.

TYPICAL BEER PALOR FOR YANKEE
If you be kind of guy wey like to go drink beer palor and you dey for dis country, you go notice de big difference between naija beer palor and beer palor for yankee. De first big difference na say for hia, dia beer palor dey sell almost any type of alcohol wey you fit think of, from beer to wine to all kinds of kai kai.
And dem dey sell dia beer from special tap. Dem go serve you de beer for draft (dis na regular glass cup) or pitcher (dis na big glass jug wey you fit share if una dey for group). But dem still dey sell beer for bottle.
And den oda differences, na say dem must close around certain time. No mata how many people still wan drink you must close. In fact ee get de way dem go don program dem cash register, de tin go stop to work when closing time reach. And so when dat time don dey reach, like 30 mins to de time, de bar tender go begin shout 'last call'. Dat one mean say if you still wan buy drinks, make you hurry buy before dem close.

SPECIAL EDUCATION (special ed.)
Ok..., for una wey get pikin for dis country, make una shine una eye read dis post well well! And for de rest of una, make una learn sometin new from dis post. Dis post na about one group of students for primary and sekondari skools. Dem dey call dis ones special education students (or special eds).
Dis students really dey special. Dem get dem own program for any skool wey dem dey. Dia own teachers dey different. And most skools get dem own special class. And when dem wan write wetin dey like WAEC for hia, dem own quesions dey different.
I remember one of my first work for yankee, I been teach small for one sekondari skool for my area. I notice say ee get dis students wey de skool tell me to give special attention. If I give classwork, I need to give dem less quesions and extra time to finish. I get to read de quesions to dem sometimes. And if dem special condition dey very serious, den dem get specialist wey go teach dem.

FAMILY MATA,
SKOOL
MY CASINO EXPERIENCE FOR LAFAYETTE, LOUISIANA
Last weekend I been go one casino wey dey near my town. Dem dey call am THE BOAT, wey dey for Lafayette for Louisiana. No be my first time to go dia. But ee don tey small since I been go. Casino na place wey I feel say I dey go troway my money..., lol. I neva go dia before den win money. Me and gambling no be friend at all. I feel say why people no dey too win for casino na because for dia beer na free oo! I dey tell you. Drink as you like and spend excess. Lol!
Anyway sha, dis time when I go, I been win small money. But na afta I don play for long time. Me I no dey go near dos black-jack tables. Na for de big fish dem. Na de slot machines I dey anchor, plenti types dey to play with small money. And whenever I go casino, I dey stay till de next day, den begin come back house around 4 o'clock for morning.
TONARDO NEARLY CARRY ME GO
When pessin dey see as nature dey scatter some places with hurricane, tornado or tsunami, you no go tink say de tin fit reach ya side. I dey always imagine wetin ee be like to experience any of dis tins. But yet, I go dey pray make ee no ever happen for where I dey.
All dat one change for me last week sunday! Ee get dis tornado wey reach awa side. De kind fia wey catch my body dat night no be small. Na so my body dey shake like leaf. Sleep fly comot for my eye. Na so I dey look for window, den watch tv to hear weather update and den comot outside to see wetin dey happen.

SEE AS AIRPORT DEY EVERYWHERE
Now wey all man don dey buy private jet for naija, I feel say now na de time for us to build at least one airport for the thirty six states wey we get. So dat all dis people wey we no know how dem make dis dem money fit dey land for any state wey dem dey go. But seriously, I also feel say dis one go make ordinary people waka around naija to dey more easy and fast. People no go too dey rely for moto to travel around.
Just like for yankee, every state get at least two or three international airport. You fit dey for ya state and fly out to any part of de world wey you wan go. And den dem get uncountable small small airports wey dey helep serve local travel. Towns we get population like fifty or sisty thousand get dem own airport. And de tin dey work well. If you wan travel go any big city, wetin you need na to join connecting flight from de airport for de small towns.

DUMPSTER
De way wey govment for hia dey keep de towns clean, go make pessin appreciate say govment dey really do dem work. For every town, no mata how small wey dat town be, dem get sanitation department wey dey make sure say dutty no dey pile up for any area for de town. Dem work na to go round to collect dutty from every house and office and den go troway am for one central dump ground.
For de apartment wey dey live, we get dis big dustbin wey dem dey call dumpster. And den every thursday, de sanitation office for the county wey I dey live, go use dia lorry to come offload de dumpster. Every single thursday, dem must come. No delay or any excuse. And na so dem go go from house to house to go collect people dutty.
If you dey live for wetin dem dey call house for hia, dem go give you special govment dustbin for you to put all ya dutty. And when dem come with dia lorry, you must put ya dustbin for near de road for dem to see. And you no need to worry, beacause say dem must come to offload ya dustbin every week.

Subscribe to:
Posts (Atom)