TRAILER TRASH

If you don dey yankee for long time, you go notice how dem get different areas for every town wey person fit live. Depending on ya money or skin color (yes oo, ya skin color mata) dem get dos wey dey live for main town (inner city), dos wey dey outside de main town (suburb) and dos wey dey live far from de main town (dem call am country, we dey call am village).

For each of dis area dem get dos wey get money, dos wey just dey struggle to survive and dos wey no too get. And de way dem divide de town, all man know where him level reach and na dia you go go find house. Most times, onyibo dey dem own side, akata dey dem own side and de latinos dey dem own side.

But ee get some kind people wey just dey different from every body. Dem no belong to any group and de way dem dey live dem life

HOW YOU FIT BUY ALCOHOL FOR YANKEE

Alcohol na big business for yankee. Everywhere you turn na so you go see where dem dey sell de tin. For tv, na so beer or wine or whiskey advert go block wetin you wan watch. Dem sponsor sports, dem sponsor movies and dem even sponsor some tins wey government dey do.

But de way dem dey show alcohol for tv and sign board and everywhere, no be same way dem dey let people buy de tin. For yankee, you no fit just enter de place where dem dey sell beer and just buy am like say you wan buy sweet. Dem get plenty rules of how dem dey sell alcohol.

De first rule na say dem get age wey you suppose reach before you fit buy beer. And dat age na 21 years. You must show
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...