'LOVE' TATTOOS

I no like tattoo since time imo river. I no fit see my sef enter tattoo palor, den com sidon make anoda pessin use pin dey chook my body with dat dem electric pin. And den come begin inject my body with dem ink. My body na no go area for tattoo.

But when I look around, na so almost every pessin get tattoo for body. People dey get am for every part of dem body. Just tink of any part, somebody get tattoo for dat area. And tattoo business her dey very big. Na none stop customers wey dem dey get.

NAIRA VS DOLLAR EXCHANGE RATE

Dis post na some kind of true confession. All of us know say aside from de beta life wey we dey travel abroad for, anoda big reason wey we dey travel abroad and de country wey we dey choose, dey depend on de exchange rate of de currency of dat country money to NAIRA.

Why wey dey like to travel to countries like USA, Canada, UK and so on, na because dem currency dey high. Na one of de reason me I decide to come yankee. When you make dat dollar and den press ya calculator to see how much ee be for naira, ee dey give you confido.

YOU NO FIT SEND ANY SMALL PIKIN MESSAGE FOR YANKEE

You know..., sometimes ee get de kind of tins wey you see or experience around you for dis yankee wey go make you miss naija. Some kind tins wey you fit do or say for naija and no mean any tin, but if you do am for hia, ee fit land you for serious wahala.

To discipline pikin hia na no no. No even tink am! Even sef, you no get right to discipline ya pikin de way you want. If you do dat one, na im be say na police attention wey you dey find. I know some parents wey dey even fia dem own pikin wey dem born.

AKATA COMEDIANS

One of de ways wey I dey take pass time when I no get anytin to do, na to go for youtube to watch jokes from stand up comedy. Sometimes, I go spend hours just dey watch stand up comedy. I go watch white, akata, latino and even naija stand up comedian.

But I dey usually enjoy akata stand up comedy. De style of dis comedians just dey different. Dem no get filter for dem mouth when ee come to POLITICALLY CORRECT topics. Dem go talk about any and every tin. Dem no send at all.

DARK SKIN vs LIGHT SKIN

Among akata people for hia, dem get dis tin wey dem dey always argue about. Dat tin na de color of dem skin. Yes oo! Dos wey get light skin dey tink say dem beta pass dos wey get dark skin. And dos wey get dark skin no like light skin people.

Dis tin wey I dey tell you be VERY serious mata for hia. Ee dey even cause serious quarel for among family members. Light skin family members dey feel say dem beta pass dos wey get dark skin. Even sef some parents dey show more love to de pikin dem wey get light skin. Dis na sometin wey I don witness with my own korokoro eyes.

WE FOR YANKEE SUPPOSE TANK GOD FOR SOME KIND TINS WEY WE DEY ENJOY FOR HIA

To begin talk say yankee no get light problem go be very old tory. Yes we know say when ee come to steady light, we naija no fit compare to yankee people. But I dey hia say light don dey dey steady small small since oga Buhari take ova.

Abi na oda tins like say nobody still dey wash cloth for hand, or say wata dey reach everybody house, or say coal tar reach ya very domot e.t.c. Ee get oda plenty plenty tins wey dey for dis yankee wey dey make life to dey very easy for pessin.

No wonda say afta we wey be foreigners complain of how dem dey treat us bad (racism) and how we dey miss we country, still nobody wan go back to where im come from. Deep down you know for ya mind say tins for hia still beta pass where you come from.

BACKGROUND CHECK

For dis place eh, dem go check you up and down, even sef ee remain dem to check ya pant to see weda you get anytin wey you dey hide. I dey talk dis one as ee take concern de tin wey dem dey call background check. Afta you don apply for work, or even as you dey fill de application form, you go see space wey dem go ask you if you do commit any crime before.


If you like make you lie, dat one concern you. Afta you don submit ya application form, dem go run background check with police to find out weda wetin you talk for ya form na true or na lie. And make God helep you say you no talk true.
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...