MY YANKEE FRIEND NO GO LET ME REST

Dis people no wan let me rest anytime dem come my house when I dey cook. Na so I go dey hia tins like- wetin be dat? Na wa oo..., wetin die for ya house? Wetin be dat tin wey you like to cook wey dey smell like rat wey don die for long?

See me see wahala oo! How wetin I dey cook for my own house come dey concern dem like dis? Anyway sha..., de tin wey dey worry my friends nose na my crayfish and dry fish wey I dey use cook. Dis na sometin wey no dey common hia. Even sef, most people hia no even know say you fit dry fish.

Anytime pessin wey I know travel to naija, I dey always get plenty supply for soup tins. Me I like to cook naija food for hia. Dem fast food no dey gree master my body.

But my friends dey always like my food anytime when I cook am finish. Dem go chop and almost lick plate. So de tin dey surprise me as dem no fit stand de smell of crayfish and dried fish.

Well me I don dey use to de smell sotey ee no dey even enter my mind say dis tins get bad smell. and me I no get any plan to stop to use dis tins when I dey cook. My yankee friends just need to adjust dem nose to de smell of my ingredients oo!!

MARTIN LUTHER KING BOULEVARD

As me and one of my friends been dey stroll for him moto one day, we reach one junction like dat. Den I come tell am to turn left so dat we fit see wetin dey dat street. My friend say lai lai him no go enter dat street for dis night.

'Ah ah.., wetin do de street?', be wetin I come ask am. My guy come tell me say dis side of town na de rough side- na de south side. I come later find out say de name of de street na MLK boulevard. Dis na short form for Martin Luther King boulevard.

MY FIRST RODEO


How many of una don ride horse before? For dos of una wey don ride am, how de tin dey feel for body? Me I neva fit get de mind to climb horse back. Ee dey always dey me like say de horse go fling me like stone from catapult.

Now na how many of una don ride cow? Yes I mean nama! Lol. I know say dat quesion get as ee be. But make dat one no too surprise you oo! Dis na because for hia for yankee, ee get one kind special sports wey people dey ride cow. Dem dey call am RODEO.

TRANSGENDER PEOPLE

No be small tin oo! Pessin wey God create finish, go look im sef for mirror den decide by im sef say God been make mistake to create am as man or woman. Den dat pessin go use im own hand come change im sef to anoda tin. Cold catch me for dis one!!

I tink by now everybody don sabi say for yankee, de tin wey dem claim say dem get yanfu yanfu na say everybody get de freedom to do anytin wey dem like, unless say dem no break any law. But if you don live for dis country tey, you go sabi say dat talk about freedom no be as dem dey talk am.


Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...