DIS ONE NA MY EXPERIENCE FOR NIGERIAN EMBASSY OFFICE WEY DEY FOR ATLANTA AS I GO TO COLLECT MY E-PASSPORT!

Last friday I travel go Atlanta to go renew my passport. I go change my passport to de one wey dem dey call e-passport. I don postpone dis trip too may times until I come decide to do am before March finish. And I go tell you say de waka to get my new passport no be small waka.

I start online to find out wetin and wetin I need to carry go de embassy office. My online waka come turn to full time research abi na project. I see plenty sites wey tell me different tins wey I need to carry go de embassy office. From birth certificate, local government identification letter to gurrantor letter wey I go declare all my property.

NA WA OO! SO JESUS NA BLACK MAN?


All my life for naija, na onyibo man wey I know as Jesus Christ. From de photo wey dey hang for awa church to calendar wey you fit buy for market, na onyibo with long hair wey I dey see. Even sef de "jesus film" wey we dey watch for christmas and easter get onyibo Jesus.

Na when I come yankee I come hia for de first time say him fit be black man. Yes oo..., de tin take style surprise me. Na by accident wey I hia dis one. Me and one akata guy been dey talk, him dey ask me about Africa, and him come dey tell me about dem own experience.

DIS KIND OF PUPSI and MUMSI DEM SEF

Sometimes I like to go watch basketball for sekondari skools around my area. Na one of de ways I dey use pass time for hia. When pessin no get anytin to do for friday, I go just go chill for one of dis games. Sports hia na big past time. Every skool get at least one type of sports wey dem dey play.

And home games dey big like mini carnival for dos wey dey live around de skool. Na do everywhere go dey bubble. Dos wey don gradge for de skool go come watch de game. Some people dey travel from long distance just to come watch dem former skool basketball or football games. And crowd dey plenti pass for de football games.

DIFFERENT DIFFERENT WAYS TO EAT POTATO

I remember one time wey one of my friend invite me to im baiday party, and na dia I see one special way wey you fit cook potato. Dem dey call am baked potato. De way dem dey make am na to wash de potato with de skin and just bake am like dat. When ee don, you use knife cut am open to make one long deep hole inside.

And you fit put anytin wey you like inside like cheese, bacon wey dem cut to small pieces, lettuce, cream or wetin dem dey call ranch for hia, ground beef, butter. You need to put dis tins when de potato still dey hot so dat everytin go melt inside and mix well with de potato.

MEXICAN FOOD, MEXICAN STORE and MEXICAN RESTAURANT

I like Mexican food no be small. I fall in love with dis type of food when I been dey skool. With all de fast food wey dey everywhere around de skool, I been dey find am hard to find beta tin to chop. And as I dey find de place wey I fit buy de kind food wey I like, I come jam dis Mexican restaurant wey dem call TACO BUENO.

Afta de first day, na so I begin go dia almost every time. De food just dey sweet me each time I go dia. I begin try all de types of foods wey dem get for dia menu. And I come notice say dem food cheap too.

NAIJA POLICE NA YA FRIEND SOMETIMES

As you begin read dis post, I know say you go dey wonda wetin I mean by say naija police be ya friend. Well..., I go try explain wetin I mean. As pessin wey don jam police for hia one or two times, I go tell una dis one..., if na naija police I been jam for one or two times, I for no suffer de kind tins wey I suffer for yankee police hand.

De very first tin wey you go learn for dis country wen you begin drive na say- de fia of korofo na de beginning of wisdom. Once you just see dem moto, ee go be like say na ghost wey you see. You go grab ya steering, and you go begin drive slow slow. Na so ya heart go begin beat fast fast.

DATE OUTSIDE YA RACE

Dis na topic wey I don postpone tire, but today I don try get enough liver to talk about am. Na de tory of wetin ee be like to date pessin wey come from anoda race, weda na onyibo, chinese or latino, all join.

I no wan begin sound like say me I be casanova, but when ee come for woman mata...., well I go talk say I no dey carry last for dat department. And yes I don date babe from anoda race. And I no go begin use dis my blog to talk say babes from anoda race beta or worse pass babes from my race. Woman na woman. All de good tins and de bad bad tins you go find for ya own race dey for oda people race. Dat one na known fact, I don experience am from both sides.

NEXT WEEK NA SPRING BREAK

Party time don come again for students for hia. Na dis time when young people get all de time to do all dem gbedu wey dem don dey plan tey tey. March na de month wey most skools, from primary to university dey give dem students one full week to go rest.

But most students no dey rest at all. Na party party all of dem dey do. And na for southern yankee wey students dey usually go to party. Dis one na because around dis time, de northern states still cold, and most of de party dey happen outside especially for dem beaches. So places for south like Maimi, Las Vegas, New Orleans and even some parts of Mexico dey full yanfu yanfu with undergrad students. And na dat time hotels and night clubs dey make plenty money.

AMERICAN FOOTBALL, na wetin yankee people dey call dem own football, and come dey call FOOTBALL, SOCCER.


Dis american football tin na one sports wey I don try well well to understand but no still know wetin dem dey do. First of all dem dey call am "football", but na mostly with hand wey dem dey use play am. And almost everytin wey dem dey do for de game resemble wetin rugby players dey do for dia game.

For hia, american football na very big tin. Almost every skool from junior secondari to university get dem own football team. De skools get football programs wey dem dey organize like professional sport programs. Each skool must get standard field. And each team must get dem own supporters club wey dem dey call marching band. Dem go dey play music through out de game.
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...