HOME SKOOL

You know say pessin fit dey house finish all im education from kindergarten to SS3? Yes dis one surprise me when I find out say ee dey possible. And ee dey popular for here.

To make ya pikin to go skool from house, you need to obey some laws wey de govement for ya state go give you. And you get to buy de textbooks and oda skool tins wey regular skool students need. You need to dey supervise ya pikin and to make sure say dem dey do all dem skool work. Dem get to write test and exams to show say dem dey do dem skool work.

Most of de parents wey dey do dis one na dos wey feel say regular skools no dey teach dem pikin well, or dem feel say de skool no dey safe for dem pikin, or dem feel say de skool dey spoil dem pikin. Some parents wey dey travel well well dey prefer to teach dem pikin for house.

Some research don find out say pikin wey go skool for house dey sabi book pass some wey go regular skool. Dis one fit be because of say de papa and mama make sure say de pikin do dem skool work.

MY FIRST WAKA TO DENTIST OFFICE

Abeg oo, make you no call me bushman afta you finish to read dis post. No be my fault say I neva visit dentist office before until 23rd December. I neva see any reason to visit any dentist. I neva get any serious tooth ache before. And anytime I look for mirror when I dey brush my teeth, I dey feel say de tin dey clean.

Come to tink of am..., na who we you know for Naija wey dey regularly go dentist office for check up? Anybody wey I know wey don go see dentist, been go because im get problem with im teeth. Our usual way na "cure before prevention".

RACISM REACH FOR BURIAL GROUND

Nothing dey jolly about tory wey concern burial ground. Na place wey everybody know say na dem final destination, but nobody wan really talk about am. But ee get some people wey get enough liver to talk about am.

In fact, I don jam people wey don make arrangement about dem own burial. Even sef, dem don buy plot of land and build dem own grave. I don see family wey don buy space or burial ground and come share space for every member of dem family!

For my village, if pessin die, na for im family compound dem go bury am. Some dey even bury inside house. Like when my granpapa die (I no meet am sha), dem bury am inside him room. De same tin too happen when dem bury my popsi mama.

GROCERY SHOPPING

Now to my fellow guys wey dey Naija, make I ask una sometin. You remember de last time wey you and ya wife or ya significant oda go market to buy tins. You still remember as she make you carry all de tins wey una buy? You just de follow her for yansh and dey frown ya face like pessin wey lick lime. But you no fit talk anytin because say you no wan hear her mouth.

Hmmmm......, Naija guy go gree follow him woman go market to go hold shopping bag for her? Unto which levels wey dat one go happen? Naija men and dia ego wey big pass dem head, go gree follow dem wife go market or go helep her buy house tins? "A whole Him"!

TYPICAL YANKEE APARTMENT(FLAT) part 1

For dos wey no know wetin apartment(flat) for yankee be like, dem go learn new tins from dis post. And dos wey dey live for apartment for yankee go agree with me. I purposely wan talk about apartments because na de one I sabi well well and na de most common type of "house" wey people dey live. And na de one wey my money reach. I neva get enough money to rent or buy house.

Now you need to understand say de way wey we de use dat word- house, no be de same way dem dey use am here. House for here na place wey get im own separate compund and sometimes im own fence. And you no get to share anytin with any oda person.

DOUBLE DIPPING

Wetin I wan talk about for dis post fit surprise some people. De tin too been surprise me de first time wey I experience am. For yankee, I notice say people no like to eat from de same plate with anoda person. Dem dey call am double dipping!!

Me and one babe been dey on a dinner date one day. So as we dey eat, she come tell me say she no like de meat wey dey her plate. Well...., I stretch my hand with my fork to collect de meat from her plate. Den I come notice dis frown for her face. She say I no suppose do like dat.

EVERY STATE GET DEM OWN FLAG

De main identity of any country na dem flag. You go see each country flag during olympics or world cup or for front of dem embassy. People dey use dem flag to connect with oda of dem country people. Once you see ya country flag anywhere outside ya country, you go know say ya country person dey around dat area.

Most big cities for yankee dey allow foreigners to celebrate dia independence day, and each country dey fly dem flag like no man business. October 1st for most big cities like new york, dallas, los angeles and maryland na green-white-green everywhere. Naija music and food plenty yanfu yanfu.

BROWN, GARNER AND OBAMA DAUGHTERS

Nobody wey dey live for dis country go say im no notice de tension wey don dey go on for one week now. No be news say korofo and citizens no too dey friendly for dis country, especially between korofo and akata people. Almost everyday, you go hia complain of bad tins wey police don do.

And for de past seven days, tension just dey grow for most part of de country. People dey protest wetin don dey happen for missouri and new york. For de place wey dem dey call ferguson wey dey missouri, one olokpa (darren wilson) shoot one boy (Michael Brown) six times, leave im dead body for road for four hours. And de case don dey on since august. Den last week, de grand jury come out with dem judgement- NOT GUILTY!! Say de police man no do anytin wrong.
Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...